Ticker

6/recent/ticker-posts

GERM WEY MANY PASS GERMANY

On the outside Dem be like GEM; but for real, Dem be the GERM
GERM wey MANY pass GERMANY; gold diggers wey wan JAM MONEY
If eyeservice na their ANTHEM, omo, na to freestyle THEM
If Dem wan service you with mouth, na to knack Dem FEM
.
Hands on a bowed man
.
Dem fit disguise like Santa but their gift na still QUANTA
If Dem challenge with BANTA, I attack with a COUNTER
Their bobo sweet like FANTA but their strategy no ENTER
I'm still the winner at the CENTER; all eyes on my SCEPTER
.
If not for you my God, shebi by now I for don MENTAL
You dey burst - you dey burst my medulla OBLONGATA
I for don kolo if no be your hand for my MATTER
You made a circle of blessings, and you place me for the CENTER
.
Dem no fit stop my GRIND; na pepper full this BLENDER
No matter the GENDER, can't stop my AGENDA
All Dem evil AGENDA; back to the SENDER
Even if na ELDER can't stop my golden MEDAL
.
Dem pọfọ̀ on top my matter but their buta no hold water
Wan use apple take my glory; I no gree do the trade by barter
Dem pọfọ̀ but no still trabaye; Olúwa ò gbédè wan
I speak in tongues no dey ṣàlàyé; na heavenly language

Post a Comment

0 Comments