Ticker

6/recent/ticker-posts

MY SIX-SIX NEVER DIES

Gone are the days of hungry man size SAPA
When my belepotmus be no dey see FULANI
As long as I got more than a big sized PAPA
I no pray to Man-made gods; not before a FOOL I KNEEL
.
Dice Icon and Graphic
.
Na Baba God dey give SIX even though na human being ROLL DICE
I just dey ROLL ON like DICE coz the Lord who holds me never DIES
I Face barriers with my AXE; and I begin to DICE
Based on sey winners never quit, One day I go break the ICE
.
I no too SABI NEWS but I sabi who sabi pass SABINUS
Na him wey hold FUTURE still inform me sey my glory FEATURE
A God that got the whole WORLD in his hands put his whole WORD in my hands
I dey HALLOW this him HALO of a HELLO wey comot me from life HOLLOW
.
Dem talk sey life na TURN by TURN but everytime na my TURN
Based on sey Oluwa no dey use me play WAYO like the game of TEN-TEN
DICE wey roll short of SIX don follow one way miss road and must U-TURN 
Me and God na five and six; na him dey DOUBLE my SIX-SIX
.
Simply riding on GRACE not to be ridden by life's CRAZE
Mine's not a photocopied RACE; so I no go run at your PACE
No matter what PLAYS, I'm destined for my own PLACE
Ain't one of life's PREYS; I always live a life of PRAISE
.
Based on sey life na DICE; with God my six-six never DIES
Sey make I too dey EXPLAIN; I no dey inside that Ex PLANE 
Men around shouting TROUBLE but God made my blessings DOUBLE
My God be using all RESORT to showcase my blessed RESULTS 

Post a Comment

0 Comments