Ticker

6/recent/ticker-posts

NA BABA SET THE COMPASS

Accara and moimoi get the same source no mean sey you no fit spot out the difference
No matter the whether, Khaki no be leather - No matter the bobo, Blood is thicker than Zobo
With the signs and wonders wey my arinze don face see, wetin God no fit do no exist
Monkey dey work baboon dey chop - na before be that; coz now, na God dey dash Monkey banana
.
A shining globe amidst others
.
Dem be wan CHARGE me with PRESSURE but na my VOLTAGE high PASS
Koto Aye wey dem dig all in the name of "Digging Deep"; I jump am PASS
No be sey na my MATH SET but na Baba set the COMPASS
Goliath block road for COMMON ENTRANCE; but Baba help me PASS
.
I dey ball with Mercy for this MANcity to get MAN UNITED through the gospel AGAIN
My words go forth with DENcity into the DEN of lions to make Daniels out of men
Based on sey Holyghost speed na him dey reign, Dem don dey feel my velocity like a moving train
Only Beside still waters, I GO LIE AT, can't even be stopped by GOLIATH 

Post a Comment

0 Comments