Ticker

6/recent/ticker-posts

THE LORD WHICH IS, WHICH WAS and IS TO COME (rev 1: 8) inspired by scriptures

#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems
.
Found no fuel in the book of MICAH for MY CAR; life be show me PEPPER

But when I SAW JOHN SOURJURN with Jehova RAPHA, ths SURGEON healing give me GINGER

Before ESTHER showed up A STAR, she be ASKING what's wrong with HER SKIN

No be by sey ESTHER BLEACH LATER, but na God ESTABLISH her EARLY

THE LORD WHICH IS, WHICH WAS and IS TO COME (rev 1: 8) inspired by scriptures - inspired by scriptures,poetic gospel,God,poetry,

.

Me wey run go ITALY make my life TALLY, see sey e still stand still like STATUE

I START TO get STARTLED, but God reminds me that I'm a STAR TOO

Bros JAY AIMS at turning SOULS into GEMS, like how he saved JAMES from spiritual GERMS

Even MOUTH wey be dey smell PISS, has been converted into his MOUTHPIECE

.

When Pharoh army wan chop me like KETCHUP, na God no let dem CATCHUP

Who get ear wey no FIT LISTEN laslas go end like the PHILISTINES

Any PHARISEE wey no wan gree SEE FAR, starts LOOSING FAR like LUCIFER

Just Look before you LEAP like PHILIP, while you still FIT LEAP
.

Lamb SLAIN in PLAIN to make us SANE from all our PAIN
So No dey hype the SAD YOU SEE like sey you be SADUCCEE
Lion king of the tribe of JUDAH; Serve him but not like JUDAS
You don't neef to have A SCRIBE's STORY to ASRIBE God all the GLORY
.
Upon sey I get teeth pass lion, life still play me like I'M A PIANO

Yet I'm not FUCKED UP by this life 'coz God loves me; I'm HAPPY I KNOW

This knowledge stops Life hands from fingering me like sey I'M HER PIANO

Exactly why I'm happier than sister HAPPY even without AMAPIANO

.

I have received the grace of perfect EASE from the God that IS

I call it the grace to chop life like YAM from this God called, "I AM"

The grace to win WARS through WORSHIP without WARSHIP from the God that WAS

I no fit shout OR PARA like OKPARA except the "shout out" na for this God that "IS TO COME"
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems

Post a Comment

1 Comments