Ticker

6/recent/ticker-posts

DON'T WORRY, BE HAPPY

#love_poem_for_her #love_poem_for_my_girlfriend #love_poem_for_lover #love_poetry_for_crush #marriage_poems_short #marriage_poems_for_couple
.
My number one no fit be FIRST BANK; me always BANK on God FIRST
Just as WARRI no dey carry LAST, Who dey WORRY fit no carry FIRST
Though this life and HER PAILNESS is FOR REAL, HAPPINESS is FOR FREE
Life's HAPPY when, "Don't worry" is HER PICK; if SHIT happens, use HARPIC
.
#love_poem_for_her #love_poem_for_my_girlfriend #love_poem_for_lover #love_poetry_for_crush #marriage_poems_short #marriage_poems_for_couple

Baby boy without worry happy laying on big adult palms

DON'T WORRY, BE HAPPY - poetic gospel,poetry,best puns,name puns,
.
This life no be my MANAGER; na me suppose dey MANAGE HER
Coz I no wan be JOHNNY just COME CLOSE after wey JOURNEY don GO FAR
As TIME no dey WAIT for CURRY, man must THYME the WEIGHT of COREY
No be only PIKIN dey drink HAPPY HOUR; ADULT sef suppose HAPPY every HOUR
.
PETER PARKER grows COBWEBS like ABC, coz BROOM no get PACKER for APC
Naija commot THE GREEN for flag kpai like DAGRIN no mean sey make we sell our GRIN
So prove The SOLDIERS WRONG to have SOLD THEIR RIGHTS breaking the SOUL JAR LEFT
After all No matter how far PETER WAKA; Afterlife, remember PAUL WALKER
.
Everybody no fit be ENOCH; Life engine go kpai laslas once E KNOCK
You wan go heaven without kpai like ELIJAH; break that thought like A LIE JAR
Before LIFE LEAVE YOU, make YOU LIVE LIFE; and may your GRIN be ever GREEN
Don't spoil the GIFT of the PRESENT with failures of the PAST or worries of the FUTURE
.
You fit dey pass through life's TOLGATE make you still smile like ambassador of COLGATE
happiness is a FREE STYLE like DONE EASY; try dey FREESTYLE am like DAN DIZZY
Laslas na ADONAI I dey ADORE NOW; If no be him, who else got power to ADORN NA
MASCARA can't makeup for life's MASSACRE but PRAISE CONVICTION is CRAZE EVICTION
.
God bless me no be SINZU ACQUISITION so no need for ZAZU ACCUSATION
Using the WORD PER DICTION against the WORLD'S PERDITION and in ADDITION
I PRAY for DISTINCTIONS without DISTINCT SHUNS; make the EMBER GO without EMBARGO
Baba Please, FLOOR the HOLES to make me WHOLE; till I got no more GROUNDS for FLAWS
.
E get why God ADD THE OPTION of ADOPTION; I'm ABBA FATHER made no be ABA MADE
Wey Fire wey wan BURN AGAINST who BORN AGAIN; I don BORN AGAIN not to BURN AGAIN
Life for treat me anyhow finish like ONE ANT; if to sey Holyghost no be my TENANT
This makes God my PARENT, that's why he lives in me but no dey PAY RENT
.
#love_poem_for_her #love_poem_for_my_girlfriend #love_poem_for_lover #love_poetry_for_crush #marriage_poems_short #marriage_poems_for_couple

Post a Comment

0 Comments