Ticker

6/recent/ticker-posts

I AM THE PRESENCE OF GOD

#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature
.
E be like sweat when I SECRETE PRAISE; result of a HolyGhost burning in the SECRET PLACE
The way I am being PASTORED by the Spirit, I no need be PASTOR to fit run PAST ALL
I no need BLACK COLLAR cloth nor WHITE COLLAR job as long as Jah's my TRUE CALLER
All PERKS ON ME sey the Spirit BECKON ME; no WRECK ON me since I RECKONED with Him
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Big boss lady in corporates, guided and protected by big hands

I AM THE PRESENCE OF GOD - poetic gospel,poetry,prayer,praise/worship,
.
This stone-COLD life wan SHORT me but God has made me a HOT SHOT
Na Jesus be the high heels that makes me look taller than the giant
Despite the FOE CURSE, I remain the FOCUS of God's BLESSINGS
Baba dey GUIDE me make I no GLIDE; na him dey SIDE me make I no SLIDE
.
I am the PRESENCE of GOD; in me lies the PRE ESSENCE of God
My Body na HOUSE wey Jesus dey HOLD; call me his HOUSEHOLD
Nothing is SIN IN ME because Jesus is SEEN IN ME; righteousness is the SCENE IN ME
My body is his TEMPLE; so Holy Spirit don temple run wetin no HOLY COMOT my DOMOT
.
I see through BLOCK ICE with His OPEN EYES; I am his BODY, no BOUNCER fit BODY me;
Much ADO ABOUT NOTHING; But with Christ, MUCH I DO ABOUT SOMETHING
Any KAPPON wey dey CAP ON forgetting sey Jesus has the final sey don ready lose him CAP
DON JAZZY go know sey even if DON JASI, if e battle God, go turn burnt food wey no even DON
.
My Words are His WORDS and His WORD is my WORLD
My TAUGHT are his THOUGHTS; My TOUCH is his TORCH
My MIND is His MIND; so world men dem no fit get MIND reach me
Na me get HAND but na God dey WORK; Na Him long LEG I use dey WALK
.
No be POWER BUTTON God take ON ME; so NEPA Got nothing ON ME
I dey CONTROL UP, I dey CONTROL down; I dey CONTROL LEFT - CONTROL RIGHT
Dem try SPACE BAR but no SPACE for my BAR; so when I ENTER, dem CONTROL DELETE
I COMMAND COMMANDOS to CONTROL SHIFT, so dem no fit sift me like WHEAT
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Post a Comment

0 Comments