I am rugged and wosky; no be my AKANUCHE
When devil start to study me; him sef know sey I be ICHIE
He study he no graduate; darkness no comprehend light
Satan no get level for the street; na me comot him street right
.
.
God get big eyes pass Irene; dey look you pass ARINZE
Mount night vigil on top your matter; E no dey slumber - nor sleep
Leave your Mathias give am, make He carry for him headpan
Based on sey God be your PAPA; you no fit login to SAPA
.
The day baba God shoot me; e pass musical video
The shoot capture my soul from head to toe
See as I shaprapra based on my God; Ominiprapra
Dem rush me like shawarma based on my God; Jehovah SHARMA
.
0 Comments