Ticker

6/recent/ticker-posts

DRIPPING GLORY

 

Me I Sabi ELOHIM; as in I say HELLO to HIM

Jehovah ELROI wey no dey do LÓRÍ IRÓ

JIREH no dey lie o JARE; no be LYING MUHAMMED

Jehovah TALK & DO wey get mouth pass TAEKWONDO

.

.

Eeasy like ABC for men to change like APC

No even reason TIE & DIE; God true colour no fit DIE

Even HELL SHALL DIE but ELSHADAI no dey DIE

YAWA fit chop you like SHAWA if no be YAWEH dey lead YOUR WAY

.

As life dey dribble like RONALDO, the God of MERCY caught me

Plenty drama like MERCY JOHNSON but God had MERCY on my JONZING

Dem wan GBAS me make I POTATE but God GBOS Dem - Dem ROTATE

E pass DRIP into my STORY; now I'm DRIPPING GLORY

.

Dem wan DRAW me back like OKRO but SHALOM was SHA my ALUM

Sin SEE CANOE soap no Japa till washed clean by Jehovah TSIDKENU

Jehovah SHAMMAH whey dey for me like sweet SHAWARMA

If he still dey your heart DOOR dey knock; open before ENGINE go KNOCK

Post a Comment

0 Comments