Ticker

6/recent/ticker-posts

REAL VIBES ONLY - My real vibes revived; I got sure vibes to survive

Since God cut grace for me; na so so cash out

Na Convoy of Angels anytime I dey matchout

Too much money; na so I begin dash out

Testimony taste money; I no fit shout

.

.

Love wey no get part two; blessing overdose

Wetin I dey see na so so open doors

More than wetin I need, na im papa endorse

All my rivals nko? Blow commot like dust

.

You no fit stop my DESTINY when THERE's STILL KNEE to pray

I go faster than the BENTLEY on my BENT KNEE; no be play

With God as my team player, nothing fit stand my prayer

My kabash bash their Kabal; even break their calabash

.

My real vibes revived; I got sure vibes to survive

King-kong with strong tongues; my life no fit go wrong

I got the power to take charge and shock them like electric

I pass all my life exam; my God never fails me

Post a Comment

0 Comments