Ticker

6/recent/ticker-posts

TEN OVER TEN - friday freestyles

Satan be send TEN ANTS come but I no gree become their LANDLORD

The OCTOPUS wey he send, I give that one TEN TACKLES

SADISTS jam me start to LAUGH like sey I dey give them TEN TICKLES

Based on God no dey fail me, life give me TEN over TEN

.

.

I no proud like fake tits, but na God bless me; I can't FAKE IT

So when HAPPY people SHOW THINGS, me sef go dey SHOW TEETH

Without God's free AIRTIME per seconds; tell me! Who dey BREATHE

Na God hold the DRUMSTICK, my life no fit go OFF BEAT

.

Too much blessings fall on me, even haters don dey CHOKE

The blessing dope pass COKE; e dey break YOKE no be JOKE

Enough SHOWERS of blessings; omo, this one don dey SOAK

Even bottle wey don break no fit talk sey he don BROKE

.

#kleezy_freestyle

Post a Comment

0 Comments