Ticker

6/recent/ticker-posts

HAPPY NEW YEAR TO EVERY EAR

It is a full fresh new AIR HERE; happy new YEAR to every EAR
Our destiny no dey WHEEL CHAIR; it's God's WILL for us to CHEER
Incase that old year wasn't FAIR; GRACE go bleach this one no FEAR
You go dey FRONT no be the REAR and enjoy favours whey dey RARE
.
.
As far sey Baba God dey FOR YOU; no kpaikpai fit to FALL YOU 
Who wan SPEAR you by ANY MEANS, God no go SPARE that ENEMY
Dem no go RIP wetin you SEW, As you dey REAP wetin CHRIST SOW
Na God hold the CARDS no matter WHAT; so life no fit use you play WHOT
.
Na Grace carry you reach HERE; no BE MOLUE BUS Shey you HEAR
You know sey no be sey you MỌ̀WÉ; na God clear the road for MÃ’WE
No drop for CHALLENGE BUSTOP proceed to PRAISE NONSTOP 
Your destination no be CELE-BUSTOP; but jubilation and CELE-BRATION
.
If NORWAY talk sey NO WAY, na to follow God; e KNOW WAY
Na life dey BOBO sey NO ROAD, so me FOLLOW God whey KNOW ROAD
Instead of to UPHOLD for HOLDUP; YAHWEH go open up YOUR WAY
God go high your GEAR pass the mass's JEER make the breakthrough CLEAR pass CLAIR bag 

Post a Comment

0 Comments