Ticker

6/recent/ticker-posts

PSALM 32:8 - bible verses, scriptues

Test and trials dey shout HELLO, wan show me SHEGE like HELL OH
Sweet Temptation just dey HOLLA me like HOLLANDER yoghurt
No matter how many times Dem HI me, I no follow their HI-WAY
This Movement on the HIGHWAY; I dey follow-follow Jehovah YAHWEH
.
Man on highway on God's word confused
.
Baba na you Sabi set the kind compass wey go fit INSTRUCT me wella
This life manual dey your hands coz Baba na you CONSTRUCT am; 
Incase life try OBSTRUCT movement; Baba help me RECONSTRUCT am
Make Enemy whey wan DECONSTRUCT wetin you CONSTRUCT self-DESTRUCT
.
Baba, the only way my MISTAKE fit TAKE MISS na if you GUIDE me as I GLIDE
As the APPLE CAUGHT up in God's EYE, make Delilah no fit CUT EYE for me
The PROS and CONS of life; Satan only gets the CONS FIRED
Holyghost gets the PROS fired; he's the friend in whom to CONFIDE 
.
As long as I dey roll with the MOST HIGH, I no need to smoke to be the mOST hIGH
Who dey reason to PEPPER me; how you wan take PEPPER GOD eye na
I be the apple of GOD EYE; na him GRACE cross-check my WORK dot my "i"
My GREAT TANK is FULL of my GRATEFUL heart of THANKS 

Post a Comment

0 Comments