Ticker

6/recent/ticker-posts

BULLION VAN with BILLION FANS

Can't A FORD to be in a bad MOTOR; GOD IS GOOD na my MOTTO 
Christ said BMW(Be My Wife) pass ROMEO-JULIET love; he became my ALPHA ROMEO 
Like a MASERATI I'm jealously TAKEN; Now my owner fights my battles like TEKKEN 
I no be MOLUE BUS wey dey enter trenches; my will na the wheel in the hands of my BOSS
.
Postal Mailing and Shipping services illustration
.
Like A FREE CAR larger than AFRICA, God take us from Peanut to PEUGEOT 
Right from the GENESIS till INFINITI, life no fit DODGE the fact sey I PORSCHE
I get mouth - God be the mouth source; I get LEG - God be my LEXUS
I get mouth like kettle; e long like LONGITUDE,  e be like LIMOUSINE
.
The ÈMINI TÍ Ń JẸ́ ÈMINI inside of me don nkack me full RIDE no be MINI
Ride wey DEEP pass JEEP; e nice and CRIS pass CHRYSLER 
No be professor SAKURA get the ACURA but na JAH get the JAGUAR 
Based on Christ my Gee wey pass G-WAGON, I'm a loaded BULLION VAN with BILLION FANS
.
EARTHLY things wan bring my HYUNDAI but for HEAVEN I keep my EYE ABOVE
For this VIGIL, I know sey I YAWN DIE but God na VIGILANTE wey no dey SLUMBER
On the cross road of indecision many don turn skeleton VOLVO
But Those ZUZU wey try SUZU my KEY; baba SUZUKI dem far away
.
No matter AUDI thing goes, I'm going YONDA not HONDA
Talking the PAST, I MESSED THAT up; talking PRESENT, I won't MERCEDES up
Jehova no dey GO-SLOW, e dey run the levels KIA-KIA
Based on the Holyghost speed, even MAZDA dey call me MASTER
.
I dey LAMBANO prayer dey ride on am like LAMBORGHINI 
Me and JAH roll like ROLLER COASTER; coast clear - the road ROLLS-ROYCE
Na the prayer on my BENT KNEES dey make me speed pass BENTLEY 
Through the vehicle of the prophetic, Elijah don run pass FERARI
.
FOOT WAGON no be VOLKSWAGEN; so no be LEGEDEZ BENZE I take LEG AM
My TOYOTA OUTRUN HUSSEIN BOLT but no RUN OUT of fuel coz extra OIL excess for my LAMP 
Na GRACE carry me reach here; no be ACADA, no be GOCADA OCADA
I follow CROSS red sea on top DRY LAND; I no order BOLT or use flying BOAT

Post a Comment

0 Comments