Ticker

6/recent/ticker-posts

ONLY JESUS BE KING

Na from the GENESIS of this TRANCE FORM the REVELATION don dey TRANSFORM 
In my CHRONICLES of KINGS, na only Jesus be KING; all others na KINGSLEY 
I don't need a LEVITE TEA COURSE to know that HE BREWS as the sweet ALL-MY-TEA
I dey talk PROVERBS dey sing PSALMS in HYMNS of HIM as the swift ALMIGHTY
.
King Jesus text with crown wall Paper
.
My MOUTH CHEW the book of MATHEW like e be chewing stick
I don LOOK the book of LUKE; my LUCAZY boost pass LUCOZADE
I don brew the book of hebrews and e don high my morale
I romance the book of Romans sotey ERRORS vamoos from my EROS
.
I no be sleeping JONAH wey like to ACT drama like sey na him paid JOB
Cain cane no fit touch me like Abel coz I bear the MARK of the Lord Jesus Christ 
When life looks UNFAIR and FISHY like TITUS; FAIR enough, it's Christ my friend that JUDGES
My blessings get him book of NUMBERS; I still dey count - e no dey finish

Post a Comment

0 Comments