Ticker

6/recent/ticker-posts

NA JESUS DEY RUN AM FOR ME

Dem wan Bianca my Facebook make dem teargas my irene
Dem wan dissolve my soul with fear; and evaporate my spirit with kpai
No wam sha! Coz if God be FOR ME, no one fit FALL ME like mango tree
I no need be HUSSEIN BOLT because na Jesus dey run am for me wotowoto
.
Jesus with two thieves on the cross under Jesus' big face
.
Dem fight me with COUNCIL of ELDERS till God CANCEL their HEADERS 
The same line wey be wan STRIKE THROUGH me, God use am UNDERLINE me
Since Bros Jay carry me put for SHOULDER; my shine's been BOLDER 
Dem don dey notice me pass ITALY like a print in ITALIC
.
Allow the WORD cap you LEGIT make the WORLD no cramp you EDIT
Na from chochocho we take dey enter chocolate but na to pray make your CHOCO no LATE
And Jesus wept; no be small Marine pour throway for him irene like RAIN
Dat marina no fit flow in vain as long as him blood flows in your VEIN 

Post a Comment

0 Comments