Ticker

6/recent/ticker-posts

RAGGAE TO RAGGA

It's not about HOW FAR; not all about HOW MEGA
As long as you got the God called ALPHA; and OMEGA
You're meant to burn brighter than the endpoint of a CIGAR 
connected than a WIFI; bridging gaps like Julius BERGER
.
Happy dancer dancing photo ideas
.
JIREH no go let you SUFFER; he never made you a BEGGER
Sey Your testimony still dey BUFFER; no mean shoulder no go still BUGA
Challenges beefing you SO FAR; you go chop Dem like BURGER 
And spread well on top the SOPHA; based on you don turn ALAGA
.
No be sey na rocket science; na just for God to pull the TRIGGER 
And your Holyghost speed go pass bullet; forward ever BIGGER
The difference go too clear once na God handle the DIGGER 
You go JIGGY pass JIGAWA if you let God handle the JIGGER 
.
God no dey run out of grace the way money dey finish for PAGA
Your RAGGAE no go reduce to BLUES; na from RAGGAE to RAGGA
Your barrels no go make NOISE but make NEWS wey dey trend like SAGA
Devil na oga lie-lie wey dey turn men to MUGU but you no go follow for the MAGA
.
Exercising my Spirit and Soul with the WORD; no be YOGA
Lion wey wan try block me, na to tear am like sey samson power tear TIGER
JAGAJAGA throw me DAGGER; the way I dodge am sweet me like SUGAR
God's love making me GAGA; now Holyghost drunk no be LAGA
.
God made me a Fisher of men; no be AGAR - no be BOGGER
I am not just interested in the small catches as I no be COUGAR 
I go after big souls too; reconciling them to the FATHER makes me EAGER
To change their life story to glory to Glory from MEAGER 

Post a Comment

0 Comments