Ticker

6/recent/ticker-posts

PARA

Whatever dey PARA LIES give me; Baba make dem PARALYZE
Frenemies dey jealous me dey PARA, dey SHOOT my PARACHUTE 
No WAY for their PARA; Even if e WEIGH pass PARAguay
And when their PARA DIES, I go still LIVE kampe for PARADISE 
.
man praying
.
As I dey PARAPHRASE the WORD, the PHRASE PARA for WORLD people
My shark FIN PARA for the red sea; PARAFIN dragon wey no dey run out of fire
PARASITE wey wan suck me don temple run when dem SIGHT my PARA
Dem ANNOYED that when I PARA, it always gets them PARANOID 
.
Same PARA wey SHOOT my PARACHUTE wan still FOIL my PARAFOIL 
My race dey PARA for the METER like HUSSEIN BOLT PARAMETER
As a BALLER wey dey PARA, my BECKHAM shots get PARABOLA
Dem PARA sey my GRAPH dey rise but no fit tear the PARAGRAPH 
.
These DUCKS just dey quack but dem think sey na PARA; Oh! What a PARADOX
Whenever you see sey I dey PARA SHA, na because sey Bible na my PARASHAH 
The love of Christ legit - no be PARAMOUR; this gives me boldness to PARA MORE
Too much miracles just dey PARADROP; so my PARA go increase e no go DROP
.
Sapa PARA LACKS give me by mistake; I clear am sey na error due to PARALLAX
I no let the Sapa PARA near my DIME; can't shift my PARADIGM from God's riches
When DEFEAT's SOLE PARA for my foot mat, God's loving PARASOL no let me see THE FEET
Try dey Use this God's PARASOLETTE on time,  make you no go PARA SO LATE
.
As I SHAPRAPRA with my SHARP PARA;  na so I SHAPROPRO dey PARA like a PRO
Prayer go help you Put on the  PARA MEANT for you like a PARAMENT of temperament
Just as me and this TRUTH PERPENDICULAR, me and dem LYINGS PARALLEL
That's why I dey PARA HELLO in GRAMS to God on all sides like PARALLELOGRAM 
.
Dem use PARA MOUNT me edge to edge based on my PARAMOUNT dey try
Dem wan use PARA take GUN me down; but as the PARAGON, I no go down
The Wèrèy Gun SILENCER go work if you no Sọ̀rọ̀ sókè on time; gbóhùn sókè right now before you no go fit PÁRÀ SÍTÁ MỌ́.
Before dem gbasgbose me sick with headache, I don TREAT their fuck up like PARACETAMOL

Post a Comment

0 Comments