Ticker

6/recent/ticker-posts

I GET DIVINE BACKING

Inside life - Dem be wan send me PACKING; Dem forget sey I get BACKING
Me I focus on the FRONT THING, so let the dogs do the BARKING 
Gone past the REAR LIES NATION into this true REALIZATION 
Sey the WORLD dey feel my FRONTINGS because the WORD be my BACKING
.
Jesus behind a believer walking on sea
.
Life gives men PUNCH on DAILY TIMES; but me dey make NEWS as a god
Death wey dey throw men overboard sef shock sey I still dey on board 
BRAGGING RIGHTS keeps DRAGGING LEFT; all my BOASTING is in God
Because I get divine BACKING,  WALKING ALONE is obviously Odd
.
I no chase dream reach HUSSEIN BOLT; na GRACE help me RUN am
Dem give me pass RONALDO crown, all because of God's MERCY 
TREND wey I FOLLOW INVOLVE no be to FALL LOW but EVOLVE 
This movie no be HOME ALONE; This moving no be WALK ALONE
.
I WALK with God the FATHER; this chases dem haters FARTHER 
I WALK with God the SON; keeps me shining than the SUN
I WALK with God the SPIRIT; Holyghost Joy High Spirited
I WALK with host of ANGELS spreading this word pass EVANGELS

Post a Comment

0 Comments