Ticker

6/recent/ticker-posts

I DEY WIN BEFORE I FIGHT

My shield of FAITH's so DYNAMIC that my FATE can't sink like TITANIC
I prayed and GOD HEARD; I'm now in the HERD of the GODHEAD
Being part of the SHEEP didn't come CHEAP; cost God his son to save my SHIP
I'm Spirit led like a FOLLOW-SHIP in FELLOWSHIP with Christ my FELLOW SHEEP
.
soldier with amour backed by a lion
.
Devil's like a young roaring lion but na Christ be the King LION
I don't fear wolves in sheep clothing 'coz my good shepherd's the ruling LION
Secures me beside still waters; on the green pastures that I LIE ON
And when I wield this sword of TRUTH, the devil can't tell any LIE ON
.
Wolves stand gidigba like JERICHO but when baba show Dem JERECOIL
They Never knew I was on fire like THAT as Dem chikey me with their fiery DART
Dem nakana  reach FORTY-FIVE but thank God I 'm FORTFIED
I dey win every WARFARE; Jericho challenged and their WALL FELL
.
I dey win before I fight; no be by GIRAGIRA-DUET
So Winchi man whey dey study me no fit ever GRADUATE
Enemy wey carry COMPASS Don miss road follow where e PASS COME
Based on If God no set the COMPASS, that gbege no fit COME TO PASS
.
Bros jay don collect all the BRUISE sammer me the best wine he BREWS
Opponents dey fall first like morning DEWS; I no dey lose and no dey DEUCE
Dem want make I SICK for the ISAAC that I SEEK; they only make noise - I make the NEWS
Dem come in QUEUES to suck my JUICE but dem ConFUSED seeing Christ and I FUSED
.
Dem confident sey I go KOLO but that was dem thinking on COLOS
I dey HOLD STRONG pass STRONG HOLD coz baba dey hold me STRONG 
JÉSÙ MÁ PAMÍ NÀÁ; too much love OVERDOSE 
Can't entice me with WORLDLY PLEASURES; I TREASURE God's love OVER THOSE 

Post a Comment

0 Comments