Ticker

6/recent/ticker-posts

DEM DEY COLLECT WOTOWOTO

#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems
.
I use the SWORD called the WORD; no be mathematics SURD of the WORLD
So I no need to calcuLATE; based on my CALCU too dey FAST and PRAY
As the Lion King BACK me UP FRONT; others BARK their dog voices DOWN BACK
Even My Angel no fit fall GIRIGBA-GIRIGBA, but stand GIDIGBA like AGIDIGBA
.
Boy kneeling before one lion shielded by Angel from other lions and people in the shadows
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems
.
Dem raid the market, ENTER PRICE; but no fit still buy my ENTERPRISE
If God says yes, who goes dem WIZARD; dem must concur nod head like LIZARD
Evil Witches with WEAVIL WISHES no understand how God PICK ME like BEANS
Na dem be the CHIEF CROOK wey wan THIEF blessings wey my God COOK
.
Penalty for who no wan let me score my goals, dem must CATCH FIRE
As Dem form COMMANDO, God go kpai their CANDLE and off their NEPA HELPER
Dem forget sey God na my SHEPHERD; so dem wan chop me like LIVESTOCK
But I sit in heaven dey LAUGH as God shame dem like LAUGH-STOCK
.
GOD TOOL no be like MAN TOOL; me dey DISMANTLE with THIS MANTLE
Once my PRAYER CONNECT; opposing PLAYERS dem dey COLLECT wotowoto
I don't use the ALTER MOST, but God blesses me UTTERMOST like who UTTER the word MOST
No matter POSITION, Na my God given POSSESSION dey make me POSE every SESSION
.
I got God's RELEASE of REAL EASE to help me REFUSE to be their REFUSE DUMP
If God no defend me from their RUBBISH, Dem for don RUB me with their ISH
REPROACH na teir APPROACH but God COACH me to kpai dem like COAACROACH
Dem ATTACK my COUNTER of THIS GRACE, but God COUNTER their ATTACK with DISGRACE
.
They were MEAN using CROOK; now, Nemesis AVERAGED dem the PLAGUES
God's MEANS for me don COOK; I'm now, the WAITER served the PLAQUES
Baba INSTALL all that's IN STORE for me; FAVOUR SIGNS, no LABOUR SIGHS
WEED lift and return you to GRASS level; but the MOSTHIGH eternally lifts me HIGH
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems

Post a Comment

0 Comments