Ticker

6/recent/ticker-posts

from B-U-T to BEAUTY - SUNDAY VIBES

 This God get COMPASSION, him heart no be STONE-COLD

Na him dey block the pump action; up till now, devil no CODE

God's word must come to pass; na devil no get the BARCODE

Good things go find you come with COMPASS; seek first the kingdom - you go turn GOLD

.

.

Those wey go meet Devil to fit fly; life's marathon makes Dem ALL CRAWL

My only option na Yahweh; I no fit draw back like OKRO

Block wey wan freeze me don melt; me sef I hot - mo gbóná

God dey answer me sharp-sharp; no draw matter like OGBONO

.

Shebi Satan be wan draw my future but he no get that kind pencil

Then I CAUGHT Jesus in the ART of COURTING me with his ART

You no fit dey with this kind ARTIST make your mind no dey AT EASE

All the B-U-T wey be dey has been painted into BEAUTY

.

#kleezy_gospel

Post a Comment

0 Comments