Ticker

6/recent/ticker-posts

KING OF IGBORO - Friday freestyle

God don bless me; I no dey borrow-borrow

Ọlọ́wọ́ gbọgbọrọ; for mortal kombat, I be Goro

King of IGBORO - king of IGBORO oh

.

.

I respect the people like the legendary zoro

When Dem cutting down irokos; me no fall - Mo ṣì dúró

King of IGBORO - king of IGBORO oh

.

From woro sí woro; I be Odogu ní gbórò

I get leg like like montaro; I get mouth like kettle, bro

King of IGBORO - king of IGBORO oh

.

I respect my aburo; me, I no dey do ojoro

From now till tomorrow, my footprint no fit kúrò

King of IGBORO - king of IGBORO oh

.

I no fit terrorize the people like sey na me be sorrow

But I dey patronize the people like the king of IGBORO

King of IGBORO - king of IGBORO oh

.

My fame for IGBORO don spread pass Coro

Dem dey sing my story like sey na Christmas Carol

King of IGBORO - king of IGBORO oh

.

#kleezy_freestyle

Post a Comment

0 Comments