Ticker

6/recent/ticker-posts

PADI MI - Based on your melody; Na why I call you my lady

Number one reason why I call you padi mi

Is if I offend you, you gats to pardon me

Unlike Adesua, you are still the single you

So why not bank on me like a W

Na you talk sey you hook up with Bankole

Dat one no mean sey you no fit still Bank on me

I don dey look God teytey make I no for look odd

But when I look you, you no look me; hin no still even

.

.

Based on your melody; Na why I call you my lady

You change am for me like you be APC chairman

It's uncool to treat me like sey I be your uncle

Shey you dey whine me ni; why you wan friendzone me

O gbona feli-feli; I call you fire girl

I be your number fan, but you're a fan of fireboy

Treated you like mama wey born me, yet your choice is Burna-boy

If love is the mama, then our story be like P-SQUARE

Post a Comment

0 Comments